ig.news
6

Dem ARREST Priests say dem Celebrate Mass for this Coronavirus Panic

Dem don arrest at list 3 fadas because dem celebrate Mass for public for this coronavirus fear, na wetin CatholicNewsAgency.com report on March 31.

Dem arrrest Fada Deogratius Kiibi Kateregga on March 29 say im celebrate Mass with people wey reach 15 for St. Joseph for Mpigi, Uganda.

For Kerala, India, dem don charge two fadas, two seminarians and three reverend sisters say dem break government order after dem celebrate mass inside their chapel for one small seminary.

For the same Kerala, dem arrest Fada Paul Padayatti on March 23 say im celebrate requiem Mass with people wey reach 100.

Them later release all of dem come warn dem make dem no celebrate mass for public again.

Foto: © Mazur, CC BY-NC-SA, #newsHqppgxxkee