ig.news
33

Real Catholics dey Against Life-Stream-Bishops (video)

Police no gree make hundreds of Catholics attend mass for Divine Mercy Sanctuary for Krakow, Poland. The people gather on Divine Mercy Sunday (on April 19 for the church even though bishops beg dem …More
Police no gree make hundreds of Catholics attend mass for Divine Mercy Sanctuary for Krakow, Poland.
The people gather on Divine Mercy Sunday (on April 19 for the church even though bishops beg dem make dem join online instead.
Police use grids stop dem make dem no attend Mass wey only five people dey allowed to assist.
Many of the faithful wey dem lock outside kneel down for front of the church wey dem close dey pray rosary.
#newsZcghxjqxij
ig.news
10

Nuncio announce: Dem don Stop Match Box Communion

Swiss Nuncio Thomas Gullickson answer for private email wey dem ask am say Chur diocese don do sometin about the match box communion, after dem tins don spoil finish. The diocese tell Gullickson say,…More
Swiss Nuncio Thomas Gullickson answer for private email wey dem ask am say Chur diocese don do sometin about the match box communion, after dem tins don spoil finish.
The diocese tell Gullickson say, dem go make sure say "everybody understand say dis dem no accept dis practice."
The question wey wey dey ask remain how person wey no understand dis, dey do "pastoral work."
#newsTizjyxwlwx
ig.news
21

Teddy Bear: Fadas dey Struggle to do Mass without People (Video)

One Fada, wey no get anybody wey im go wash im fit on Holy Thursday decide say im go wash feet of imaginary faithful. Another desperate fada wey no see any other solution but to perform the same Holy …More
One Fada, wey no get anybody wey im go wash im fit on Holy Thursday decide say im go wash feet of imaginary faithful. Another desperate fada wey no see any other solution but to perform the same Holy Rite for im teddy bear (the two videos dey down).
We no know where the videos from. But dat aside, the videos dey show the tragic decline of Catholic Liturgy.
#newsYlpysvryzf
ig.news
166

Na becos of this dem Close all Churches?

One priest for Polish Church try to sing Easter Alleluia. The answer wey im receive no dey too good too #newsRphczqkxjbMore
One priest for Polish Church try to sing Easter Alleluia. The answer wey im receive no dey too good too
#newsRphczqkxjb
osdamen
To jest sprawnie przeprowadzony montaż dźwiękowy, podkładu "śpiewu" Niestety wielu się dało nabrać na ten wątpliwy "żart". Dopowiem ku pokrzepieniu …More
To jest sprawnie przeprowadzony montaż dźwiękowy, podkładu "śpiewu"
Niestety wielu się dało nabrać na ten wątpliwy "żart".
Dopowiem ku pokrzepieniu zrobionych "na szaro", że też dałem się nabrać tej chamskiej manipulacji.
ig.news
11

Chinese Regime don Accept Anti-Catholic Vatican Magazine

La Civilta Cattolica, one Jesuit magazine wey dey publish every two weeks and wey Vatican Secretary of State dey review, don start digital Chinese edition. Their website address na www.gjwm.org E no …More
La Civilta Cattolica, one Jesuit magazine wey dey publish every two weeks and wey Vatican Secretary of State dey review, don start digital Chinese edition.
Their website address na www.gjwm.org
E no dey surprising sha say Communist mainland China fit access the page, although the Communist regime don dey use the Great Firewall since 1997. the Great Firewall na infrastructure wey China dey use censor Internet use, so that dem go also block pages wey get Catholic content.
One of the pages wey dem block na www.gloria.tv
#newsNhzryxdozr
ig.news
12

German Bishop: No mass for am na "Luxury Problem"

For Magdeburg Bishop Gerhard Feige, as Catholic no like say coronavirus stop Mass dey "whiny" (Katholisch.de, April 20). Him tell Christians make them pursue dia "particular interests" like lobbyists.…More
For Magdeburg Bishop Gerhard Feige, as Catholic no like say coronavirus stop Mass dey "whiny" (Katholisch.de, April 20).
Him tell Christians make them pursue dia "particular interests" like lobbyists. For Feige, if we compare the tins wey coronavirus don cause, the work wey nursing staff dey do, and the economic wahala now, say dem cancel church services na "almost luxury problems."
Him hate say people dey tok about "health dictator" and say dem get "some differences" between dictatorship and "state wey dey practice democracy" wey stop common good because of common good.
Feige reject the idea say make dem dey allow some pepole come mass, say e dey "impossible to decide" who fit come, and to monitor whether people go follow the rules.
Feige only want make dem allow church services when e fit happen for "more naturall and more humane way."
Foto: Gerhard Feige, © Thomas Guffler, CC BY-SA, #newsSwugcxpmgo
ig.news
35

Lowest Level of Disregard: Police Hold Phone for Fada Face as Mass dey go on (Video)

Elderly Fada Lino Viola celebrate one funeral for church wey dey 300 square meters for Soncino, Italy with thirteen people wey wear gloves and masks. Dem allow only seven people with the cantor, altar …More
Elderly Fada Lino Viola celebrate one funeral for church wey dey 300 square meters for Soncino, Italy with thirteen people wey wear gloves and masks.
Dem allow only seven people with the cantor, altar boys and person wey dey stream the event, but Viola no pursue other six family members.
So, as the mass dey on, police officers waka enter dey shout, "We suspend this service." Them fine Fada Viola with 270 euros say im no obey the coronavirus regime. Viola no stop the mass.
So, one policeman try to give am phone make im talk with the mayor. Fada answer: "I no fit answer mayor; I dey say mass." Him tell the policeman make im no interrupt mass. Finally, the police come commot.
Viola tell LeNuovaBq.it (April 20) say for im 80 years of life and 55 years as fada, him never see where dem disrespect mass like this.
#newsSfdrciqsdt
ig.news
19

All Join: Pick Up Your Communion for inside Match Box

Stans parish, Central Switzerland, dey offer take-away Co,mmunion for their three churches. Dem wrap the hosts wit white, match boxes wey dem do by themselves. One sign wey dey use hand write say: "…More
Stans parish, Central Switzerland, dey offer take-away Co,mmunion for their three churches.
Dem wrap the hosts wit white, match boxes wey dem do by themselves. One sign wey dey use hand write say: "Consecrated hosts wey you fit carry go for Home-Communion." For 90 minutes, people fit pick up any number of boxes.
One woman tell the bishops' Kath.ch say she and her parents dey take the take-away Holy Communion while dem dey watch mass online.
On Holy Saturday, people carry about 70 boxes, and even more on Easter Sunday. The local Church diocese follow.
#newsGiuvmrurii
ig.news
21

How Cardinal and Governor Fool People

Governor of New Jersey, wey im name na Phil Murphy tell Newark Cardinal Tobin for middle of March for phone say him dey "really concerned about the drive-thru Holy Communion." Murphy tell Tucker Carlson …More
Governor of New Jersey, wey im name na Phil Murphy tell Newark Cardinal Tobin for middle of March for phone say him dey "really concerned about the drive-thru Holy Communion."
Murphy tell Tucker Carlson of FoxNews.com (April 15, video dey down) say Tobin quickly reply, "We no go do am, I promise you. I go confirm with my fellow bishops."
Becos of this tin, Tobin suspend all sacraments on March 18 "because we dey concider the faithful health."
On March, Murphy publish one kyn stay-at-home order wey allow make person leave house for "religious reasons."
Carlson no gree say "government no dey allowed to tell people how to worship" and him ask the Governor, why liquor stores dey open while churches dey locked. Murphy reply say to shut down liquor stores go lead to mental health issues and addiction issues wey wey no plan.
#newsBqrkbgirtb
ig.news
36

Former "Vicar of Christ" don become Leftwing Activist

Francis, wey be former Vicar of Christ, spend Holy Week and Easter dey do leftwing activism. On Good Friday, him send card wey im write with im hand go give Italian extremist and the Luca Casarini, …More
Francis, wey be former Vicar of Christ, spend Holy Week and Easter dey do leftwing activism.
On Good Friday, him send card wey im write with im hand go give Italian extremist and the Luca Casarini, 52, wey dey traffic human beings, dey call am "dear brother," dey thank am "for your letter wey Michel [Cardinal Czerny] bring for me," and add say, "Count on me."
On Easter Sunday, Francis send letter give members of "popular movements and organizations" wey people wey follow na left-wingers wey no believe in God, wey dey support gay, support abortion and wey dey against family. Him call them "social poets."
For Roberto Pertici (Settimo Cielo, April 17) the "primacy of politics" as Francis dey show am na one of the tins wey dey show Church "internal secularisation."
#newsKdzorrfebr
ig.news
49

Bishop About Coronavirus Regime: "We don see this tin Before"

The coronavirus restrictions remind Greek Catholic Oradea Bishop Virgil Bercea, 62, Romania, of the time when dem dey under Communist dictator Ceausescu. "We don see this tin before," na wetin im tell …More
The coronavirus restrictions remind Greek Catholic Oradea Bishop Virgil Bercea, 62, Romania, of the time when dem dey under Communist dictator Ceausescu.
"We don see this tin before," na wetin im tell CatholicNews.com (April 11), "The situation make us remember when dem close churches for more than 40 years under communism, when we no get any possible way to worship, not to tok of to celebrate Easter."
For communism time, the only tin wey remain na prayer for house. Bercea believe say even though the situations dey different from dat time, "the tins wey dey happen na almost the same tin."
So, "many people say the situation for communism time don come back."
Foto: Virgil Bercea, #newsHtiukwjtyy
ig.news
11

Vatican no Accept Dialogue Request

Fada Benoit de Jorna wey be the Superior of the French District write for him March newsletter say The Society of Saint Pius X (PiusX) ask the Vatican say dem go like get some serious toks about dogma …More
Fada Benoit de Jorna wey be the Superior of the French District write for him March newsletter say The Society of Saint Pius X (PiusX) ask the Vatican say dem go like get some serious toks about dogma wey concern controversial issues (LaPorteLatine.org).
As e be, the Vatican reply say "now, we no get plan to go back to dogmatic questions."
For PiusX, to agree on theological matters dey important so dat we fit finally concur with the Vatican.
The theological wey PiusX get with Congregation for the Doctrine of the Faith (2009-2011) end with no results.
#newsLbdmthkkud
ig.news
26

First US Bishop don Remove Restrictions for Public Mass

Las Cruces Bishop Peter Baldacchino, New Mexico, don lift the ban for public Masses, weddings and funerals, na wetin CatholicNewsAgency.com (April 15). Baldacchino write give im priests say the Mass …More
Las Cruces Bishop Peter Baldacchino, New Mexico, don lift the ban for public Masses, weddings and funerals, na wetin CatholicNewsAgency.com (April 15).
Baldacchino write give im priests say the Mass ban "no fit become the status quo for the coming future."
Him dey encourage Masses wey dem dey do outside and for parking lot, but im stress say priests must respect civil restrictions wey say make more dan five persons no gather.
But him no gree with government decision wey call churches "non-essential" services
Foto: Peter Baldacchino, #newsCybycxlvex
ig.news
43

Pachamama 2.0: Cardinal Cupich Perform Sky Idol Ritual (Video)

On January 7, Chicago Cardinal Blase Cupish perform Chinese Lion-awakening Ritual before him go preside for Carnel Catholic High School for Mundelein, Illinois. Them dey do the ritual to "bless" one …More
On January 7, Chicago Cardinal Blase Cupish perform Chinese Lion-awakening Ritual before him go preside for Carnel Catholic High School for Mundelein, Illinois.
Them dey do the ritual to "bless" one new lion dance costume and the ritual involve to offer food and incense to the sky idol. Dem light two candles so dat the idol fit see the offering.
The "blessing" na to dot paint for the lion eyes, nose, mouth, ears and body. Cupich na im do this part. Him invoke like dis:
"Good fortune for your head, miraculous light to dey shine for your eyes, your ears dey hear sounds from all directions. Make the big fortune and profit wey go favour you pass dey for you throughout dis year, from the beginning till the end."
Dem dey use Lion costumes for Chinese New Year for the lion dance wey dem dey do to sacare the Nian monster and to give luck for the year wey dey come.
#newsHijppojznj
ig.news
10

Francis' Sword of Mercy don Kill Again

On April 15, Francis "accept the renunciation" of Spanish-born Callao Bishop Jose Luis del Palacio y Perez-Medel, 70, Peru. Palacio follow for the Neocatecumenal Way, and be friend of Lima Cardinal …More
On April 15, Francis "accept the renunciation" of Spanish-born Callao Bishop Jose Luis del Palacio y Perez-Medel, 70, Peru.
Palacio follow for the Neocatecumenal Way, and be friend of Lima Cardinal Cipriani wey don retire (Opus Dei) wey Francis replace on January 2019 with the anti-Catholic Archbishop Carlos Castillo.
Palacio spend the last 44 years for Peru where him take care of the "poor, people wey dey prison and people wey people dey marginalize."
But dis no help am cos, as MarcoTosatti.com tok on April 16, him refuse Francis Communion for adulterers "and so, for no reason wey we know, dem force am to resign."
For gesture of clerical delicacy, Palacio receive the news say dem don remove am from Easter Eve.
#newsCyaweqwopk
ig.news
22

Crazy Germans: Bishops' President Believe say "Faithful" Gay Couples dey "Blessed" by God

Right Now, "many people" dey get the message say the Church dey do "prohibitive morality" as e take concern sexual morals, but him wan change dis, na wetin Limburg Bishop Georg Batzing, wey be the …More
Right Now, "many people" dey get the message say the Church dey do "prohibitive morality" as e take concern sexual morals, but him wan change dis, na wetin Limburg Bishop Georg Batzing, wey be the President of the German Bishops Conference tell Faz.net (April 12).
To give example, him no mention paedophila wey the political left don dey preach for decades, but "same-sex relations," na de wan wey him mention, another political left favourite.
"For [un]moral theology, we don since don dey say: if real love and faithfulness dey, we need to acknowledge am. People dey decide how dem wan live afterall. We fit tell dem say their relationship dey under God blessing?" - na wetin Batzing explain.
As e be, proper moral theology know say true love no dey sinful and "faithfulness" to sin na wetin dem dey call "vice."
Foto: Georg Bätzing, © Bistum Limburg, #newsAmurlkwdup
ig.news
16

Francis: "Whisky na the Real Water of Life"

TheTimes.co.uk report (on April 15) say the Vatcan don remove the Video of Francis wey im dey collect bottle of Scotch from Scottish seminarians, dey call am "the real water of life". Francis joke wey …More
TheTimes.co.uk report (on April 15) say the Vatcan don remove the Video of Francis wey im dey collect bottle of Scotch from Scottish seminarians, dey call am "the real water of life".
Francis joke wey fail na part of documentary about Scottish Seminary for Rome. Dem record am last year for Apostolic Palace and dem go share am for BBC Scotland on Sunday.
Vatican officials say dem must commot Francis remark from the film.
The "water of life" (Rev 21:6 and 22:1) na the Holy Spirit (CCC 1137)
#newsSmlugqhouj
ig.news
15

Cardinal Shout like Demon

"Any time wey emergency dey, I no dey against confession thru video," na wetin Leiria-FátimaCardinal António Marto wey no no anthing tell ReligionDigital.org (April 14) even though dat kyn confessions dey …More
"Any time wey emergency dey, I no dey against confession thru video," na wetin Leiria-FátimaCardinal António Marto wey no no anthing tell ReligionDigital.org (April 14) even though dat kyn confessions dey invalid whether Marto "allows" am or not.
Marto claim say "the Holy Spirit" even "dey act like dis." Sha, im see video-confessions as "unnecessary" since Francis don toksay "e dey possible to 'confess directly to God" as fa as you dey plan confess later when you get opportunity.
Like demon, Marto cry loud against the tin wey people dey tok say coronavirus na punishment from God, im say dat kyn tok na "ignorance," "sectarian fanaticism," "madness," and "e no be Christian tin""
#newsNuhfakrpqg
ig.news
11

Vatican Finances:The Next Dey Try im Luck

The Vatican on April 15 name Giueppe Schlitzer say im be the ne Financial Infrmation Authority (AIF). Person wey dey before am na Tommaso Di Ruzza, the man dey under criminal investigation. Schltzr …More
The Vatican on April 15 name Giueppe Schlitzer say im be the ne Financial Infrmation Authority (AIF).
Person wey dey before am na Tommaso Di Ruzza, the man dey under criminal investigation.
Schltzr study for United States. Him dey part of high finance: Bianca d'Italia, International monetary fund, Confidustria.
The new assistant director of AIF na Federico Antellini Russo wy don dey work for Vatican sinc 2015
Foto: © Never House, Flickr, CC BY-NC-ND, #newsZapkgxihcf
ig.news
9

Pachamama Francis: "Faithfulness no be virtue wey wey dey respect"

Francis preach on April 14 about Rehoboam wey "start to worship idols." Him tok say we fit argue say "we nevr kneel down for idols" - [no be like the Pachamama worshippers for where Francis dey] But …More
Francis preach on April 14 about Rehoboam wey "start to worship idols."
Him tok say we fit argue say "we nevr kneel down for idols" - [no be like the Pachamama worshippers for where Francis dey]
But dis no go be excuse for Francis, "e fit be say you no dey knnel, but na true say you dey fyn dem and you dey worship dey for your heart. Self-assuredness na im dey open door for idols."
Him conclude say, "Even for our midst, with other people, faithfulness no be wetin we dey value well well."
#newsWtxpbeevne