ig.news
16

God and Saint Paul na Pegans - Archbishop

The Milan Archbishop Mario Delpini tell LaStampa.it on March 16 say "Prayer no be to ask God to remove punishment wey him send, we no get God wey dey vex wey need make dem appease am,"

Him go on say "That image na image of peganism"

Milan get the biggest diocese for the world, and na there be the centre of coronavirus problem for Italy.

The religion, accoring to Delpini, no be Christian

Saint Paul talk say "God dey release judgement from heaven against ungodly people" (Rom 1:18) and say "the anger of God dey come for people wey dey disobey" (Eph 5:6, Col 3:6)

God himself talk something about people wey dey break him command: "I go visit una with panic, with disease wey go finish una and fever wey go consume the eyes and make una heart ache" (Lev 26:16)

#newsBzqlspmyqd