ig.news
ig.news
195

"Proselytise": Bishop Quote John Paul II take Correct Francis

"some Church leaders [= Francis] dey tel us wetin no corect, say when we dey tok about missions, make we no dey 'proseltise'," Na wetin Tyler Bishop Joseph Strickland, Texas, write for TheWandererPress.com …Ọzọ
"some Church leaders [= Francis] dey tel us wetin no corect, say when we dey tok about missions, make we no dey 'proseltise'," Na wetin Tyler Bishop Joseph Strickland, Texas, write for TheWandererPress.com (April 27).
Strickland explain say John Paul II been tok about this way wey people dey use dis word wrongly for Redemptoris Missio 46.
John Paul II criticize say to convert non-Christians, sometimes people dey see am like 'proselytizing'."
Sha, him point out say "every person get right to hear the 'Good News' of God wey dey show imself and give imself thru Christ."
Foto: Joseph Strickland, © wikicommons, CC BY-NC-SA, #newsIniepjbhig
ig.news
70

Yin and Yang: Francis Say make people Obey Rules - no be wetin Bishops talk...

As im April Mass dey start, Francis insist say make people obey rules as the gofment for Italy dey reduce the lockdown. "these days wey we don dey come out of quarantine, make we pray to the Lord say …Ọzọ
As im April Mass dey start, Francis insist say make people obey rules as the gofment for Italy dey reduce the lockdown.
"these days wey we don dey come out of quarantine, make we pray to the Lord say make im give im people, all of us, grace and obedience make we obey the regulations so that the pandemic no go come back."
Francis comment come as the Italian bishops don suddenly stat to dey complain say dem ban all Mass.
#newsXxrvvybbkc
ig.news
62

Burke: "We need to do pass dis one"

We "no fit accept" say Catholics never fit go mass, receive communion, and go confession for weeks no, na wetin Cardinal Raymond Burke tell CatholicAction.org for interview wey dem do on April 23. Him …Ọzọ
We "no fit accept" say Catholics never fit go mass, receive communion, and go confession for weeks no, na wetin Cardinal Raymond Burke tell CatholicAction.org for interview wey dem do on April 23.
Him point say the world dey find how to solve needs. Lyk dat, make the church too bring im own solutions to bring spiritual care.
Burke regret say Italian Catholics die alone, and dem bury dem without dia family, and no priest, "We need to do wetin pass dis."
Him notice say the way wey the Church respond to coronavirus dey somehow "different" from oda times wey resemble dis one for pass, those times, the church find ways - even like heros - to minister give faithful.
#newsLnhmtdavnm
ig.news
67

John Paul II: "Heat wey dem no fit explain"

John Paul II (+2005) release heat wey i no fit explain from im body, na wetin Italian virologist Giulio Tarro, 81, tell LeFedeQuotidiana.it (April 27). Tarro feel dis when im shake John Paul II hand.…Ọzọ
John Paul II (+2005) release heat wey i no fit explain from im body, na wetin Italian virologist Giulio Tarro, 81, tell LeFedeQuotidiana.it (April 27).
Tarro feel dis when im shake John Paul II hand. Him call am "articular prana," say e fit commot pain.
"Prana" na "breath," "life force," or "vital principle" for Sanskrit language. As Hindu believe, e dey every place.
Tarro say im save John Paul II life after dem try to kill am for 1981 when the Pope lose lyk 3 liters of blood, and receive blood wey come give am infection.
"One Polish fada call me, im secretary, and I reach Rome shap shap come see say im dey sick. I no tink, I just decide to treat the infection, wey from virus, with interferon," according to Tarro.
Dem dey use interferon treat both hepatitis B and hepatitis C.
Foto: © Mazur, CC BY-NC-SA, #newsWdqirxzzsl
ig.news
61

Christians Go Pay say dem Sit down for inside Car

Police don treaten say Protestants wey dey do April 26 service for Church of God Aylmer, Ontario, Canada go pay fine. Like 50 cars gada for where dem dey park. Everybody dey inside dia cars, and listen …Ọzọ
Police don treaten say Protestants wey dey do April 26 service for Church of God Aylmer, Ontario, Canada go pay fine.
Like 50 cars gada for where dem dey park. Everybody dey inside dia cars, and listen to preaching from dia car radio. Dem no collect any offering.
Up on dat, police officers video the cars come tell CtvNews.ca say "peple go answer for wetin happen."
The Church of God don dey ask for legal advice.
#newsYhawmzvesq
ig.news
56

More Tins wey Bring the Old Rite Questionnaire tok

Francis ask for the questionnaire about the Old Liturgy, according to MarcoTosatti.com (April 26), "e be lyk say Francis meet some priests wey dey practice the traditonal liturgy and im come see for …Ọzọ
Francis ask for the questionnaire about the Old Liturgy, according to MarcoTosatti.com (April 26),
"e be lyk say Francis meet some priests wey dey practice the traditonal liturgy and im come see for imself say dem no dey 'rigid', at all."
Francis still see say the Old Rite get life, and so im wan understand am.
MarcoTosatti.com believe say d queshion "fit" no dey come from "negative will."
Him know say dem dey do am for different places: Asia, America and e go soon enter Europe.
MarcoTosatti.com no add say plans dey to "forbid" the Old Mass, and cos dis no go dey possible, but instead na to reduce am as dem dey stop Holy Week as e be before 1955, cancel the permission wey dem give generally to celebrate am, and so dem go reduce am to the small group of Old Rite priestly communities.
Foto: © Joseph Shaw, CC BY-NC-SA, #newsWbykxeqktz
ig.news
62

Italian Bishops don Finally Wake Up?

The Prime Minister of Italy Giuseppe Conte announce on April 26 say make dem open dia country again small small. Him plan to allow burial, but no be big gathering like masses with people. Italian …Ọzọ
The Prime Minister of Italy Giuseppe Conte announce on April 26 say make dem open dia country again small small.
Him plan to allow burial, but no be big gathering like masses with people.
Italian bishops write note give Conte say dem no gree, say dem - all of a sudden - "no fit gree say dem go stop people make dem no worship when dem want."
Conte reply say the gofment stil dey chek how dem go take allow masses under serious security "as soon as possible."
Foto: Giuseppe Conte, #newsDafhkcbcuv
ig.news
58

Francis: "We no dey Transmit Faith to Convice"

For Francis homily wey im do on April 25, im tok again say if we dey do evangelism, make we no try to bring the other person to our faith, even though we know say both "proselytism" and evangelism mean …Ọzọ
For Francis homily wey im do on April 25, im tok again say if we dey do evangelism, make we no try to bring the other person to our faith, even though we know say both "proselytism" and evangelism mean to convert person.
"Faith always dey missionary," na wetin Francis yarn, add say "people wey get faith gats commot, go show faith socially" and "prove dia faith with service" mean "to live the Faith concretely."
Then im come claim say Faith no be wetin dem dey "transmit to convince," but "to give person treasure," as if one go commot the other.
#newsEhsiajxqvn
ig.news
69

Amazon Ordination Replace Christian Symbols with Juju tins

Dem ordain Antelmo Pereira Angelo from Amazon wey get four pikins as permanent deacon for the Alto Solimoes Diocese, Brazil, for March 15 ceremony wey dem carry juju signs full everywhere. Person wey …Ọzọ
Dem ordain Antelmo Pereira Angelo from Amazon wey get four pikins as permanent deacon for the Alto Solimoes Diocese, Brazil, for March 15 ceremony wey dem carry juju signs full everywhere.
Person wey preside for the even na Bishop Adolfo Zon Pereira wey dey born from Spanish, dem do the event for St. Francis of Assisi church, Belem do Solimoes.
Faces wey dem paint, witch songs, dances, necklaces, bangles, headtie, animals' teeth, shells and snails. And many native tins wey dem dey use pursue evil spirits and invite other spirits.
When dem dey do the ordination, Angelo lie down for on top mat wey dem do with Tururi fibre. Na one native woman do am from Capinuri palm bark and dem say e dey protect people from the forces of nature (picture dey down).
Bishop Zon use one black chalice wey dem do from food and ciborium wey look like black bowl wey dey represent Pachamama and wey Francis collect for the Amazon Synod, for dia closing Mass.
#newsDqhosmxega
ig.news
58

Francis Insults Bats - dem come criticize am

Francis preach on April 22 say sinners dey like "human bats," wey lyk to live for dark place cos the light dey show wetin dem no wan see." Sha, the Twitter account wey the name na "Give Bats a Break"…Ọzọ
Francis preach on April 22 say sinners dey like "human bats," wey lyk to live for dark place cos the light dey show wetin dem no wan see."
Sha, the Twitter account wey the name na "Give Bats a Break" wey dey preach make people like bats, no gree for wetin Francis tok, "Bats no dey do any crime in the night, dem jus dey service our ecosystems" - as dem dey polinate flowers and trees, dey eat insects wey dey spoil plants, and dey help forest grow after disasters.
So, wetin represent bats beta na Matt 6:1, "no dey do good tins so that people go dey see am come praise you," na wetin the account tok.
The account dey complain say bats dey face "disrespect everytime, threat say person fit won or kill dem, and nobody dey thank them." So: "To dey like bats more, make people dey expect say others go hate dem even if dem do good tins."
#newsWrznohhqnn
ig.news
60

Locked Churches: Cardinal Warn of "Self-Pity", bring yarn wey no be true

Say dem close church na sometin wey "dey pain us well well," na wetin Westminster Cardinal Vincent Nichols tok for Mass wey dem dey stream online for nursing staff (CatholicHerald.co.uk, April 24). …Ọzọ
Say dem close church na sometin wey "dey pain us well well," na wetin Westminster Cardinal Vincent Nichols tok for Mass wey dem dey stream online for nursing staff (CatholicHerald.co.uk, April 24).
Dem don close English churches for more than one month now. Sha, Nichols warn say make people watch out for "any sense of self-pity as we dey play our part to save lives."
The last yarn no be true tory. For instance, Wilfred Reilly compare all US states, those wey do curfew and those wey no do (Spiked-Online.com, April 22).
Him result: Curfews no dey help deal with coronavirus pass simple sanitary distancing.
Foto: Vincent Nichols© Mazur, CC BY-NC-SA, #newsGezeatazbl
ig.news
57

Trouble dey come? - Vatican dey ask about Old Rite

Rorate-caeli.blogspot.com report say The Doctrine of Faith Congregation send out survey give all bishops wey concern to apply the 2007 Motu Proprio Summorium Pontificum wey allow the Old Latin Mass (…Ọzọ
Rorate-caeli.blogspot.com report say The Doctrine of Faith Congregation send out survey give all bishops wey concern to apply the 2007 Motu Proprio Summorium Pontificum wey allow the Old Latin Mass (the complete report dey down).
The reason: Francis wan know about the application of Summorum Pontificum. Dem send the questionnaire out on March 7, and dem must return am by July 31. Na to know:
1. Wetin diocese dey do about the Old Rite?
2. If e apply when dem need am or when fada want?
3. Wetin be e good and bad syds?
4. Dem dey respect the Summorum Pontificum?
5. The Novus Ordo don accept the original Rite?
6. You [bishop imself] dey use the 1962 missal? 7. Dem dey celebrate other sacraments for the Old Rite? 8. The tin dey influence seminary? 9. Wetin you dey advice about the Old Mass? Foto: © Joseph Shaw, CC BY-NC-ND, #newsMksvegzbnw
ig.news
37

Strange Pachamama Coincidence

Francis' Santa Maria for Transpotina Pachamama church na also the place where Fada Vincenzo teraborelli, wey be 79 years old Carmelite fada, dey cast out demons since 1991, na wetin RemnantNewspaper.com …Ọzọ
Francis' Santa Maria for Transpotina Pachamama church na also the place where Fada Vincenzo teraborelli, wey be 79 years old Carmelite fada, dey cast out demons since 1991, na wetin RemnantNewspaper.com write on January 9.
Fada Taraborelli operate from one room wey dey bak of the church where people dey come everyday, even sundays, sometimes up to 30 people for one day.
Taraborelli don become the person wey take over exorcist, Fada Gabriele Amorth (+2016).
For RemnantNewspaper.com, e no be "coincidence" say Taraborelli church, wey be center of deliverance ministry for Rome, don become center of Bergoglio demon worship.
"E just dey like say Jorge Bergoglio dey raise giant middle finger for God face."
#newsYxwpzijdcy
ig.news
39

Paris Archbishop: "We Must Stop this Joke"

Three police men wey carry gun enter Saint Andre-de-l'Europe for Paris as Fada Philippe de Maistre dey celebrate mass wey dem dey stream online. One acolyte, one canotor, one organist and three …Ọzọ
Three police men wey carry gun enter Saint Andre-de-l'Europe for Paris as Fada Philippe de Maistre dey celebrate mass wey dem dey stream online.
One acolyte, one canotor, one organist and three parishoners na im dey around.
De Maistre tell LeFigaro.fr say fada na im be the authority for Church, "the only people wey surpose enter church without permission from fada na pepole wey dey quench fire, police no suppose try am."
But, the policemen tell fada make im stop the Mass. Him no gree, so dem come tell am say im go pay fine.
Afta, De Maistre come tell Paris Archbishop Michel Aupetit, wey condemn the tin for Nostre-Dame-Radio (April 22), him still criticize say even though dem don fomally ban dem, police still enter church with weapons.
"No terrorists dey there!" - na wetin Aupetit explaijn, "We must calm down stop this joke, if not, we go tok and shout loud o."
#newsWcokmknbqv
ig.news
53

Cardinal Dolan: Prayer of the Faithful for Mass dey "Boring" (video)

New York Cardinal Timothy Dolan no know say im mic dey own, im come tok say: "I forget my water [?], I tink say we no go do the boring tins" (video dey down) Him tok dis tin during prayer of the faithful …Ọzọ
New York Cardinal Timothy Dolan no know say im mic dey own, im come tok say:
"I forget my water [?], I tink say we no go do the boring tins" (video dey down)
Him tok dis tin during prayer of the faithful for Easter Sunday Mass wey dem stream online.
Them introduce the "boring tins" - the prayer of the faithful - for New Rite Eucharist for 1970.
Even though Dolan no go gree for public, the prayers of the faithful really dey "boring" and useless since the whole Mass na "prayer of the faithful" and "general intercession."
#newsXrwnenairh
ig.news
32

Even Francis' Ghostwriter Want Make Masses Come back

La Plata Archbishop Victor Fernandez, wey be Francis follower and specialist for kissing, write one April 19 letter wey im propose ways for dem to reopen Masses for people, but "no allow fanaticism." …Ọzọ
La Plata Archbishop Victor Fernandez, wey be Francis follower and specialist for kissing, write one April 19 letter wey im propose ways for dem to reopen Masses for people, but "no allow fanaticism."
Fernandez believe say e dey necessary make dem give the faithful sign say the present situation without Masses dey "really worry us [bishops]."
Him list 13 rules wey resemble the ones wey already dey for Buenos Aires, like distancing, plenty masses, to remove sign of peace, and compulsory communion for hand.
Him intend to show say to assist for Mass no dey more dangerous than other activities, wey the State already allow.
Foto: Víctor Manuel Fernández, #newsXmlibgrkzz
ig.news
45

Vigano: Church of Council don Realise Masonic Plan, dey Prepare for Coming of Antichrist

Archbishop Carlo Maria Vigano no beleive say the Vatican publish the third secret of Fatima completely for 2000. Vigano tell Dieslrae.pt (April 21) say people wey see the secret before dem publish am …Ọzọ
Archbishop Carlo Maria Vigano no beleive say the Vatican publish the third secret of Fatima completely for 2000.
Vigano tell Dieslrae.pt (April 21) say people wey see the secret before dem publish am say e dey tok about Church apostasy wey no appear for official version.
Him blame Cardinals Sodano and Bertone for dis, and e dey strange say im pass the fact say Cardinal Ratzinger follow for the publication and even write the official interpretation of the secret.
Vigano warn say priesthood go suffer attacks like say dem go introduce deaconesses, stop celibacy, and come make am hard may people know the difference between baptismal and ministerial priesthood.
Him gues say: Francis no go officially allow female deacons but im go tolerate dem quietly if German or Dutch dioceses go ahead. Him stress say na so dem take introduce to receive communion for hand. After dat, "Conseratives" fit claim say "the Pope never allow anytin new."
For Vigano, the Council Lumen Gentium comit "doctrinal error …Ọzọ
ig.news
57

Secularized Francis dey Suffer Religious "bout" when im dey tok about Pachamama

"If we spoil the earth, the answer go dey ugly," na threat wey Francis give for im Online April 22 GEneral Audience wey im do becos of the UN Earth Day 2020. "The Earth no dey ever forgive," he yarn,…Ọzọ
"If we spoil the earth, the answer go dey ugly," na threat wey Francis give for im Online April 22 GEneral Audience wey im do becos of the UN Earth Day 2020.
"The Earth no dey ever forgive," he yarn, "we don sin against the earth."
Wetin follow dis tok na plenty yarns: "global challenges," "our common house," "one human family," "biodiversity," "house-garden," "ecological conversion."
Francis console imself say people don form plenty movements "to awaken consciences" cos "we don pollute and loot the Earth."
For am, [at least] the Earth dey "sacred" and "the Gospel of Creation," na "house of God" wey deserve "sacred respect."
Him come yarn say we learn the "prophecy of contemplation" from the "original peoples" - maybe na becos dem dey suffer from too much drug for alcohol problem.
#newsEpogqlioyr
ig.news
48

Bishop wey no get shame Attack im own Priest

Cremona Bishop Antonio Napolioni, Italy, attack the elderly Fada Lino Viola say im defend Holy Mass against police raid. Viola celebrate funeral for 300 square meter church with 13 faithful wey wear …Ọzọ
Cremona Bishop Antonio Napolioni, Italy, attack the elderly Fada Lino Viola say im defend Holy Mass against police raid.
Viola celebrate funeral for 300 square meter church with 13 faithful wey wear mask - six more wey dem "allow."
Napolioni write for statement wey dem share on April 20 say him know of the "suffering" of many priests and faithful becos of say dem ban Mass.
another "but" wey follow spoil dis statement, dey show Napolioni regret, wey no be about say dem interrupt mass, but about the behaviour of the priest wey - as Napolioni claim - dey contradict "the civil norms and canonical indications" even though the police raid dey illegal accoding to the concordat wey Italy sign with the Holy See.
#newsKyvvmhkbnu
ig.news
38

Mantra Cardinal invoke Poor, Peripheires and Plague

After the coronavirus, the middle class go become "the new poor," na weting Bologna Cardinal Matteo Zuppi invoke first Francis mantra, as im dey do internet chat with some Family associations (…Ọzọ
After the coronavirus, the middle class go become "the new poor," na weting Bologna Cardinal Matteo Zuppi invoke first Francis mantra, as im dey do internet chat with some Family associations (IlMessaggero.it, April 21).
The second Francis mantra follow immediately, when im tok about to "reconnect the wires with the peripheries" wey for am be "psychological and existential."
Him say e dey "beautiful and spectacular" say Francis create hostel for "poor" people next to Saint Peter's although dem don rent the place as hotel.
For the coronavirus lockdown, Zuppi read The Plague by Albert Camus (+1960), French author wey be atheist, womanizer, anarcho-communist, Marxist and anti-Christian.
For Zuppi, the lockdonw don "open spiritual dimension."
Foto: Matteo Zuppi, © Presidenza della Repubblica, CC BY-SA, #newsDebexasgbv